Loading...
Blaqsbi Home Huddle

Blaqsbi Home Huddle

Permalink
26

Throwback post. 2020-04-02 19:45:25.

*Relax with Nigerian proverbs in pidgin. I copied them somewhere on WhatsApp. And remember to share.*

TELL ME WHICH ONE IS YOUR FAVOURITE!

1. Na person wey never see problem dey use English dey pray.

2. Book wey no gree enter head go enter exam hall

3. Goat wey get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.

4. Who naked no dey chuck hand for pocket...!

5. Wetin concern dog with family planning?..

6.Na determination dey make Okada overtake trailer for road.

7. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load.

8. Pikin wey go strong go strong.... No be say until dem name am Samson.

9. Na over confidence make February no complete.

10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.

11.Head wey no wan think, go carry load..

12. Hand wey stay long for pocket, know say nothing dey that pocket.

13. Forget Trust If trust dey, Water no for boil Fish.

16.No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile.

17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching take start.

18. Feel at home, feel at home na im dey make visitor spoil remote control.

19. Escort me, escort me naso slave trade take start.

20. It's a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.

21. Christianity is free, but you must buy Bible

22. Person nor dey use shame chop winch o

23.Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.

24. You no need spoon and cutlery to chop slap.

25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.

26. The patient dog ... Nah hungry go kill am.

27. I go do am later na e make fowl no fly like other birds.

28. No food for lazy man no be for person wey em mama get restaurant.

29. Who dey hold landlord rentage no dey fry stew wey curry dey.

30. I am covered by the blood of JESUS, E no mean say make u no lock door sleep oooh

31.) Pastor wey dey pray for mad person no dey close eye.

32.) I wan marry, I need pikin, I need money, na e make Church overflow dey full.

33.) I know too much, i know too much na e make SAN no fit recite National Anthem.

34.) I know book, I know book, na im make you dey say merit, instead of advantage.

35.) The tin wey make egg strong for pot nai make yam also soft for pot

36.) Pikin way Say e mama no sleep, he self no go sleep.

37.) Sun 2 hot e nor mean say fowl go Lay boiled egg.

38.) Monkey smart monkey smart, nah because tree near tree

39.) Na run wey nor serious, Na in woman de hold breast.

40.) Na cooperation dey make rice full pot

41.) Cockroach wey say him sabi acrobatic dance where cocks are doing general meeting don waka kurukere waka

42.) Say Lion dey sick, no mean say him with cat na mate.

43.) This burial rich, this burial rich, na e make to die hungry elders.

44.) We go make am, we go make am, na im make village dry, Lagos full.

45.) Na economy recession make teacher use ruler measure yam.

46.) Pikin wen wan chop party rice, e no dey fear dance!!!

47.) Say cat sabi swim no make am catfish.

48.) E go beta, e go beta, na e make camel still dey cari load.

49.) I no be your mate. na e make slippers get size

50.) Park there, where you dey go, na so road block become toll gate

51.) Fish wen scatter for soup still dey inside the soup.

52 ) I never ready, i no need love, na money I want, na so sugar daddy and mummy take start.

Which is your favourite?

  
  
   5
  
Samuel Builsah

Samuel Builsah @Sam85  

Follow Samuel Builsah on Blaqsbi.

Enter your email address then click on the 'Sign Up' button.